Ghana v Gambia 2027 Afcon qualifier live updates


Ghana dey under pressure to get a result

Wetin we call dis foto, Gambia bin dey enta dis game on di back of dia 2-1 win against Somalia for Group C opening qualifier
Published

Read am in 6 mins

First Half

17″ Yaya Bojang and Colley and Baboucar don dey pass di ball among diaseff for di back bifor di keeper blast di ball inside.

16″ Ghana wit 77% of di possession but dem no create anytin. Gambia now get di ball.

15″ wit all dia possession, Ghana no get shot for di Gambia area yet afta 15 minutes.

Di Gambian defence don clear dia lines from dat Ernest Nuamah freekick.

14″ Afena-Gyan and Caleb Yirenkyi carry di ball dey enta di Gambia area, dem close di spaces so dem pass to Nuamah wey don win freekick.

Jonas Adjetey clear im lines – and win throw-in.

13″ Offside flag against di Ghana team.

12″ Joseph Ceesay drive for di wings wey im enta di box and di ball fall to im teammate wey try one weak shot. Goalkeeper Asare bin catch am easy.

Di ball now dey for di yard of di Gambians, dem dey string some passes bifor dem enta di Ghana box to try and shoot.

11″ Ghana player Oppong Peprah don play one ball into touch, im teammates vex about dat pass.

9″ Di Scorpions try to attack, Ghana recover well to collect di ball and start dia own attack.

Tins don calm down – goalkeeper Asare also dey play from di back.

8″ Gambia now try to string some passes togeda; dem bin lose am again within seconds.

7″ Di Ghana team dey play many long passes for dia strikers – but so far none of dem long balls find dia teammates.

Ghana don dey get plenty possession for di game so far.

6″ Suleimana Camara and im teammate foul Oppong Peprah, ref award freekick.

5″ Ernest Nuamah no fit collect one pas for di byline for di Gambia far left side.

4″ Jonas Adjetey play anoda long ball for Fatawu Issahaku but im no fit meet di ball.

Ebrima Adams don dey collect warning from di ref togeda wit Ernest Nuamah for di center.

3″ Di ball dey back to di Black Stars for dia territory, bifor one long ball from defence towards Afena-Gyan comot for goalkick.

2″ Referee don warn one Gambia player say dat be im last foul, di next one, im go chop yellow card.

Kwasi Sibo bin lose di ball for midfield; im make lucky say di referee don award am freekick, but dem waste am.

Di Black Stars dey begin to try to pass di ball around to dominate possession for dis early stage.

Ghana bin pass di ball for di almost empty stadium.

1″ Referee don blow whistle for game to begin.

Moroccan centre referee Mustapha Kechchaf don lead di teams.

By di end of di 90 minutes, we go see if Ghana or Gambia go win di points.

Ghana dey expected to weat dia all-yellow jersey wey Gambia go wear dia red jersey.

Very soon di players go comot for di tunnel and enta di pitch.

Tins dey set; weather dey clear, some fans also dey di stadium for dis game.

Welcome to di Accra Sports stadium for Ghana wia dis game between Black Stars and di Scorpions of Gambia dey happun.

Ghana and Gambia coaches don select dia starting XI for dis 2027 Afcon qualifier wey dey happun for di Accra Sports Stadium.

Tins don set for dis game as Ghana make desperate for dia first point for dis qualifiers.

Gambia dey look forward to get another points to boost dia chances afta dia 2-1 win against Somalia.

But di Black Stars no go make am easy.

Dis na di starting lineups for both teams.

Ghana XI: Benjamin Asare (GK), Oppong Peprah, Jonas Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah; Caleb Yirenkyi, Kwasi Sibo, Fatawu Issahaku, Thomas-Asante, Ernest Nuamah, Felix Afena-Gyan

Gambia XI: Baboucarr Gaye (GK), Omar Colley ©, Yaya Bojang, Alagie Saine, Ibou Omar Touray, Joseph Ceesay, Ebrima Adams, Abubakar Barry, Abdoulie Sanyang, Sulemana Camara, Mohammud Badamosi

Buildup

Di Black Stars of Ghana dey jam wit di Scorpions of Gambia for di second game for di 2027 Afcon qualifiers for di Accra Sports stadium.

Ghana bin lose dia first game 2-0 against Ivory Coast wey dey top di table for Group C.

Gambia for di oda hand dey second afta dem also sama Somalia 2-1.

Somalia dey third for di group wey Ghana bin dey sit bottom.

Di Black Stars dey under pressure from fans for di kontri afta dia poor game for Bouake last week.

But di coach Carlos Queiroz believe say im team fit turn tins around despite di fact say six of im key players no dey available sake of injury.

Anoda player Alexander Djiku wey captain di team against Ivory Coast also injure for dat game, im now be dis seventh key player wey no dey available for dis Gambia game.

Earlier, Jordan Ayew, Baba Rahman, Mohammed Kudus, Antoine Semenyo, Prince Kwabena Adu and Nathaniel Adjei all bin pull out.

gambia enters this game with a positive 2-1 win from their first group game

Wetin we call dis foto, Just like Ghana, Gambia also get five of dia key players missing for dis game sake of injury

Despite dis plenty injuries, sabi pipo and fans believe say Ghana still get chance for dat Ivory Coast game bifor, but di team neva click wey dem struggle to create chances.

For di Scorpions of Gambia, dia confidence don dey high ahead of dis game afta dia first group game win against Somalia.

But dem too get dia own injury wahala.

Dia assistant coach Abdou Jammeh tok say di team go miss di absent players pass di way Ghana go miss dia own players.

Musa Barrow, Yakubu Minteh, Abdoulie Manneh and Adama Sidbeh all dey unavailable sake of injury.

Wetin di two coaches tok ahead of di game

Abdou Jammeh tok for di pre-match press conference say im team go feel di absence of di five missing players wey don score 24 goals for di national team for di last months, more than di way Ghana go miss dia own players.

“Our absent players dey more important pass di Ghana Black Stars players wey dey miss dis game.”

Im add say im players already dey motivated for dis game.

“We no need to motivate our players, to dey play for di national team na ogbonge tin. Dem already sabi wetin dis game mean. We dey focused well well.”

Abdou Jammeh say “we dey hope to get positive result for dis game, our focus no dey on whether Ghana dey good shape or not, or whether di team get positive or negative statistics – we just wan win our game.”

For 73-year-old Ghana coach Carlos Queiroz, im depleted team dey ready for di Gambia game.

“We don learn from di Ivory Coast game, na so we prepare well for di attacking department to finish chances wey we go create.”

Im add say “we expect di fans and di press to support and trust us to win dis game, even though di team dey face some wahala.”

“I dey confident say wit positive football, attacking football, if we perform well, we fit win di game.”

ghana lost 2-0 to Ivory Coast

Wetin we call dis foto, Ghanaian fans dey para sake of dia team no dey perform well since di World Cup

Head-to-head and recent form

Ghana bin dey struggle for Afcon qualifiers in recent times, in fact di team fail to qualify for di 2025 Afcon, di first time for 20 years.

But for dia last five games. Ghana bin win only one wey dem lose three and draw one.

Dem also fail to score for three of dia last five game.

In fact, dem dey struggle well well to score goals. For di 2026 World Cup, di Black Stars bin score only two goals in four games.

For Gambia, dem win two of dia last five games, wit three defeats.

Dem also score for four of dia last five games.

Between di two kontris, dem jam each oda eight times for official games bifor dis game.

Ghana don win six of those games, wey Gambia win only one wit one draw.

But dis statistic no go dey important, na afta 90 minutes we go find who go win dis game.

Possible lineup for di two team

Ghana XI: Lawrence Ati-Zigi; Oppong Peprah, Jonas Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah; Caleb Yirenkyi, Kwasi Sibo, Christopher Bonsu-Baah, Augustine Boakye, Thomas-Asante, Ernest Nuamah

Gambia XI: Baboucarr Gaye (GK), Alagie Saine, Yaya Bojang, Omar Colley, Sainey Sanyang, Abubakar Barry, Mahmudu Bajo, Joseph Ceesay, Ebrima Colley, Fadera Alieu, Abdoulie Ceesay

Di game dey happun at 4 PM (5 PM WAT) for di Accra Sports Stadium



Source link

Scroll to Top